Nigerian cryptocurrency: CBN ban Crypto [Dogecoin, Bitcoin, Ethereum] trading in Nigeria as China, India, Iran ban crypto-currency trades

Nigerian cryptocurrency ban wey Central Bank of Nigeria [CBN] announce to trading in Crypto [Dogecoin, Bitcoin, Ethereum] no dey new. Yes! e don happun before for oda big kontris around di world.

Nigeria Central Bank on Friday stop banks and financial institutions for di west African nation from dealing in Cryptocurrency or facilitating payment for Cryptocurrency exchange – whether na Cyto coin or Crypto token.

Latest tori be say one financial operator [Providus bank] don suspend virtual payment services and e dey happun just afta di CBN fresh order.

Local media for Nigeria dey report say, dis decision of di central bank [CBN], na because of di warning wey dem receive from United States Federal Bureau of Investigation [FBI], concerning di activities of fraudsters wey dey use cryptocurrencies to bring hundreds of millions of US Dollars wey dey obtain illegally from USA and oda western kontries into Nigeria.

Report say to avoid detection, some wayo pipo dey send millions of dollars to Nigeria through cryptocurrencies and dis don make am difficult for di authorities for both Nigeria and US to trace di illegal money.

As e be so, no be only Nigeria don ban cryptocurrencies.

Some oda Kontriess don take similar decision in di past;

[China] Chinese authorities order Bitcoin exchanges for di capital city to close.

Wetin we call dis foto,

Chinese regulators issue strict instructions on how Bitcoin exchanges need to stop dia operations

For September 2017, China begin take move to shut down Bitcoin exchanges for di kontri, starting with trading platforms for key cities.

Dem order all Bitcoin exchanges for Beijing and Shanghai to submit plans for end dia operations by 20 September.

Di move follow di Chinese central bank decision to ban initial coin offerings for early September.

Chinese authorities decided to ban digital currencies as part of a plan for reducing di kontri financial risks.

One website set up by di Chinese central bank warn say pipo dey seriously use cryptocurrencies “as tool for criminal activities like money laundering, drug trafficking, smuggling, and illegal fundraising”.

For April 2019, China economic planning agency put Bitcoin creation among list of activities wey dem go ban.

For one notice published online in Mandarin by di agency dem add; “virtual currency mining activities [including] di production process of Bitcoin” to di list of industries wey dem go shut down.

Dem suggest say di power wey di industry dey consume dey ontributes to pollution and wastes resources.

[Iran] Authorities ban banks from dealing in crypto-currencies for Iran

Wetin we call dis foto,

Iran central bank don ban di use of crypto-currencies for dia financial centres

For April 2018, Iran central bank ban oda banks from dealing in crypto-currencies, ova concerns say pipo fit use di technology illegally.

Dem say wayo pipo fit turn Bitcoin “into a means for money-laundering and financing terrorism” and “a means for transferring criminals’ money”.

Iran currency, di rial, fall well-well to all-time low for early April 2018.

Banks, credit institutions and currency exchanges all now gatz to avoid any sale or purchase of digital currencies.

Even sef for June 2019, Iran authorities seize 1,000 Bitcoin mining machines from two former factories because of increase in electricity consumption.

Di demand for power increase by 7% for June 2019 and cryptocurrency mining na im dem say be di main cause, according to energy ministry spokesman wey tok to ocal state-run media.

[India] Central bank for India ban crypto-currency trades

Wetin we call dis foto,

Di RBI announcement make crypto-currency exchanges for India enta palava

For April 2018, India central bank announce di ban on di sale or purchase of crypto-currency.

For di kontri first policy statement for di current fiscal year, di bank tok say di financial institutions can no longer deal with entities wey dey trade in virtual currencies like Bitcoin.

Di Reserve Bank of India (RBI) give di banks three months to end dia exposure to such exchanges.

Dat period, India get around five million digital currency users.

[Nigerian cryptocurrency] Dogecoin, Bitcoin, Ethereum trading background in Nigeria

Na on 14 September, 2020 Nigeria Security and Exchange Commission [SEC] decide to dey regulate digital assets like cryptocurrency for di west African nation.

SEC say di move na because ‘digital asset offerings’ like “crypto-token or crypto-coin” dey provide anoda way wey pipo go fit invest or keep dia money as asset.

Wetin we call dis foto,

Different types of cryptocurrency

Dis ground breaking statement (dat time) bin surprise many as e be say di Central Bank of Nigeria don draw ear before give Nigerians say dealers and investors in any kind of crypto currency in Nigeria no dey protected by law.

But Cryptocurrencies whether na crypto-token or crypto-coin don dey make waves for Nigeria no be today, even outside Nigeria, many pipo don show di greatest interest in cryptocurrency world wide.

Elon Musk, wey be business mogul and one of di world richest pipo, na big supporter of Cryptocurrency as means of income and investment.

But if dis CBN policy tanda, e fit trap millions of dollars cryptocurrency money inside Nigeria wey get di second largest Bitcoin trading volume inside di world.

Nigerians don trade more than 60,200 bitcoins since 2015.